How Nigerians Can Travel To Rwanda In 2026 - Free Visa On Arrival For 30 Days, See Real Cost

 

How Nigerians can travel to Rwanda in 2026



How Nigerians Can Travel To Rwanda In 2026


If you don tire for Lagos wahala, go Rwanda go breathe.


Rwanda na the cleanest country for Africa, I no dey exaggerate. No plastic bag for road, no dirt, police dey everywhere, and Kigali for night dey calm pass Lagos for Sunday morning.


Na the kind country wey go give you strong travel history. If UK embassy see Rwanda stamp for your passport, dem go know say you no be first-time traveller wey wan run.


And the sweet part be say — e easy to enter. No embassy wahala.


Do Nigerians Need Visa For Rwanda?


No. No be say you go embassy go queue.


When you land for Kigali Airport, dem go give you visa on arrival for FREE, valid for 30 days.


Why free? Because Nigeria na member of African Union. Rwanda don waive visa fee for all AU, Commonwealth and Francophonie countries.


Now make I clear one lie wey full internet.


Many blogs dey write "Rwanda visa-free 90 days for Nigerians." Na lie. 90 days na for Ghana, Senegal, Benin and few others. Nigeria na 30 days. If you stay pass 30 days without extension, you don overstay.


If you wan stay pass 30 days, go Immigration office for Kigali before your 30 days finish, go apply for extension. No wait till last day.


Wetin about East Africa Tourist Visa? That $100 visa wey dey cover Kenya + Uganda + Rwanda for 90 days — e dey exist, but for 2026, Kenya part dey somehow. Kenya don change system. And since Kenya and Rwanda don already free for Nigerians, no need to waste $100 unless you sure say you dey go Uganda too. Check Uganda immigration portal first before you pay am.


Wetin You Need Carry Go Rwanda?


No carry only passport waka go airport o. Immigration for Kigali go ask you for these things:


1. International Passport — Must valid for at least 6 months, with at least 1 blank page. If your passport dey expire for 3 months time, dem go turn you back.


2. Yellow Fever Card — Must. Nigeria na yellow fever country, Rwanda go ask am. Make sure you take vaccine at least 10 days before you travel, if not e no go count.


3. Return Ticket — Dem wan see say you go come back. No buy one-way.


4. Hotel Booking — Book at least 1 night for Kigali for http://Booking.com, print am or save am for phone. Dem fit ask.


5. Money For Pocket — No be law, but carry like $500 - $1,000 cash or for account. E go help you settle for first days, and if immigration ask you how you go survive, you go show am.


If you no get any of these, dem fit deny you entry even though visa na free.


How Much Rwanda Trip Go Cost?


Make we talk true price, no sugarcoat.


For 4 days WITHOUT gorilla:


- Flight Lagos to Kigali return:  ₦1.35m- ₦1.5m — RwandAir direct na 5h 20m, one-way about ₦658,000. Ethiopian with stop for Addis Ababa fit be small cheaper, but journey go long.

- Hotel for Kigali (3 nights):  ₦210,000 — About $70 per night for clean guesthouse or Airbnb. If money tight, hostel dorm dey $10 - $20 per night.

- Food + Transport (Moto-taxi + Bolt):  ₦150k

- Kigali City Tour + Genocide Memorial + Lake Kivu Day Trip:  ₦150k


Total: About ₦1.86- ₦2m for 4 days


If you wan do Gorilla Trekking, add this:


Gorilla permit na where people dey confuse.


For foreigner from UK or US, na $1,500. But for us Nigerians, as African citizens, na $500 for promo. Yes, $500.


That $500 promo dey valid till 31 Dec 2026, e no dey work for June to October peak season. From January 2027, price fit change, so confirm for Rwanda Development Board before you pay. And minimum age na 15 years — pikin below 15 no fit trek.


Total WITH gorilla (using $500 promo): About ₦2.6m - ₦3m


If person tell you say Nigerian go pay $1,500 for gorilla, na lie. Na $500 be our own.


Wetin To Do For Rwanda


1. Kigali Genocide Memorial: You must go. E dey emotional, e go teach you history. Entry na free, e dey open 9am to 5pm. Last Saturday of month e dey open from 1pm because of Umuganda.


2. Volcanoes National Park — Gorilla Trekking: Na the main reason people dey go Rwanda. 1 hour with mountain gorillas. Na once in lifetime thing.


3. Lake Kivu: Fine lake for Rubavu, you fit swim, do boat ride, just relax. E near DRC border — no go near border area wey government warn.


4. Nyamirambo Walking Tour: Local area for Kigali, you go see real Rwanda life, market, food, people wey dey smile.


Money Matter For Rwanda


Rwanda currency na Rwandan Franc.


Carry USD cash — new notes, wey dem print after 2009. $100 bills get best rate. If you carry old dirty note, dem go reject am.


ATM dey for Kigali — Bank of Kigali, Equity, Ecobank. Visa card dey work pass Mastercard for there.


Moto-taxi na main transport for Kigali. Driver must give you helmet, na law. If e no give you helmet, no enter.


3 Mistakes To Avoid


1. Carry plastic bag: Rwanda don ban plastic bags since 2008. Dem go collect am for airport. Pack with fabric bag.


2. Waka anyhow last Saturday morning: Last Saturday na Umuganda — community cleaning from 8am to 11am. Roads dey close, shops dey close. Plan your airport transfer well.


3. No Yellow Card: Rwanda dey check am for airport. If you no get am, dem go hold you.


Final Advice


Rwanda na free visa on arrival for 30 days, clean, safe, and e go give you strong travel history. If you don do Benin and Kenya, Rwanda na next level.


If you never get Yellow Card, check my guide: How To Get Yellow Fever Card In Nigeria In 2026


If you wan travel Kenya next, check my guide: Do Nigerians Need Visa For Kenya In 2026?


_Note: Flight prices dey change daily. Always confirm for RwandAir or Ethiopian website before you budget. Gorilla permit for Nigerians na $500 promo till Dec 2026 — confirm for RDB before you pay, price fit change for 2027._


Comments

Popular posts from this blog

10 Visa-Free Countries Nigerians Can Travel To In 2026 Without Stress

How To Get Yellow Fever Card (Yellow Card) In Nigeria In 2026 - Cost, Where To Get Am

How To Travel From Nigeria With Only ₦500k in 2026- Cheap Travel Guide