How Nigerians Can Travel To Rwanda In 2026 - Free Visa On Arrival For 30 Days, See Real Cost
How Nigerians Can Travel To Rwanda In 2026 If you don tire for Lagos wahala, go Rwanda go breathe. Rwanda na the cleanest country for Africa, I no dey exaggerate. No plastic bag for road, no dirt, police dey everywhere, and Kigali for night dey calm pass Lagos for Sunday morning. Na the kind country wey go give you strong travel history. If UK embassy see Rwanda stamp for your passport, dem go know say you no be first-time traveller wey wan run. And the sweet part be say — e easy to enter. No embassy wahala. Do Nigerians Need Visa For Rwanda? No. No be say you go embassy go queue. When you land for Kigali Airport, dem go give you visa on arrival for FREE, valid for 30 days . Why free? Because Nigeria na member of African Union. Rwanda don waive visa fee for all AU, Commonwealth and Francophonie countries. Now make I clear one lie wey full internet. Many blogs dey write "Rwanda visa-free 90 days for Nigerians." Na lie. 90 days na for Ghana, Senegal, Benin and few others. Nig...